Dubai fire outbreak: Ajman market dey burn inside huge firebreak for Dubai Metropolitan Area of UAE

Scientificsoul
0
Dubai fire outbreak: Ajman market dey burn inside huge firebreak for Dubai Metropolitan Area of UAE
Dubai fire outbreak: Ajman market dey burn inside huge firebreak for Dubai Metropolitan Area of UAE

Massive fire break out inside Ajman market area of United Arab Emirates (UAE) on Wednesday evening.

Many fire fighting engines na im dey rush towards di spot while authorities neva tok wetin cause di fire, according to local report

  • Beirut pipo dey vex, accuse goment of neglect afta Lebanon explosion
  • Gov Obaseki remove Edo Assembly roof make nobodi do sitting afta police clash
  • According to official reports, di fire break out at 6:30 pm inside di emirate new industrial area in Ajman, wey dey some 50 km away from Dubai.

E no dey clear weda casualties dey for dis fire outbreak.

Latest update from di fire wey break out on Wednesday inside one market in di emirate of Ajman for northeast of di United Arab Emirates na say di National, Ajman Civil Defence bring di fire under control at about 9 pm (local time), media report.

Crews from Dubai, Sharjah, and Umm Al Quwain dey assist local emergency services, di Ajman Civil Defence tok.

Di Ajman market na fruits and vegetables market for Dubai emirate new industrial area. Local report say di massive fire na sake of existing goods wey dey di market.

Tags

Post a Comment

0Comments

Post a Comment (0)